Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 76:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 True-true, di way Yu dey vex judge human being, go make dem praiz Yu. Yu really dey show as Yu dey vex rish.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 76:10
20 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God tell Fero for en word sey, “I make yu king, so dat I go use yu show my pawa and pipol go fear my name for di whole world.”


And if God nor reduce di days wen dis tins go happen, evribody go die finish. But bikos of di pipol wey God choose, e go reduce di days.


Di nashons dey vex, but di time wey yu go ponish dem, don rish. And na naw yu go judge doz wey don die kon reward yor savants; di profets; doz wey dey good and evribody wey dey fear yor name, both small and big. Dis na di time to distroy doz wey dey kause wahala for di eart.”


Yu make di rof sea kwayet kon silent di nashons wey dey kause trobol.


Nashons don skata and dia kingdoms dey fall! God shaut like tonda and di eart kon bigin melt!


Naw, I know sey God big pass all di gods, bikos en pipol don dey save from Egypt pipol pawa; Egypt pipol wey wiked and like yanga well-well.”


Even doh una mind na to kill mi, but God let am bi like dat, make betta tins for happen, so dat many pipol go dey save as una dey si today so.


Na Yu set where di sea go flow rish, so dat dem nor go ever kover di eart again.


God promise dey pure well-well like silva wey dem melt for fire.


So my God, make Yu raiz-up kon judge di world, bikos na Yu get all di nashons.


E go judge evribody akordin to wetin dem do kon defend doz wey nobody dey help. E go ponish wiked pipol and doz wey dey do bad tins, go die.


But Pilate ansa dem, “Wetin I don rite finish, na so e go bi.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka