Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 74:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 My God, wetin make Yu rijet us forever? Wetin make Yu dey vex for yor own sheep wey dey yor field?

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 74:1
30 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God nor dey ready to forgive dat pesin. Instead, God vexnashon and jealousy go raiz for di pesin and all di curse wey dey dis book go bi en own.


Make una know sey na di Oga God bi God! Na-im make us and wi bi en pipol. Wi bi en pipol, di sheep wey dey en field.


Den, wi yor pipol, di sheep for yor field, go tank Yu forever kon dey praiz yor name from one generashon go rish anoda.


bikos na-im bi God. Wi bi en pipol and E dey wosh ova us, bikos na wi E dey kare for.


But naw, Yu don rijet and disgrace us. Yu nor dey follow awa sojas go fight again.


“Make una nor fear, una wey bi small sheep, bikos una Papa go happy to give una di kingdom.


God wey get pawa sey, “Una bi my sheep; di animals wey I dey feed! Na una bi my pipol and na mi bi una God.”


Dis na wetin Oga God tok: “Just as nobody go fit measure di heavens or open di eart foundashon, na so too I nor go ever rijet Israel pipol bikos of wetin dem do. Mi, wey bi God, don tok!”


“E go bad well-well for doz leaders wey suppose kare for my pipol just as shepad dey kare for en sheep, but dem nor do am, instead dem distroy and skata my pipol.


My God, na how long Yu go dey vex with us? Na forever? Na how long yor vexnashon go dey burn like fire?


So God don rijet mi forever? E nor go ever show mi en love again?


Wetin make mi nor get hope? Wetin make my heart nor dey happy at-all? But I go still put my hope for God hand! I go still dey praiz am, bikos na-im bi my Savior and God!


As long as I bi di God wey nor dey die, e go betta for una if una listin to mi. Wiked animals attack my sheep kon kill and chop dem, bikos dem nor get who dey guide dem. My shepads nor even try to look for di sheep, instead na diasef dem kare about.


My pipol, make una listin to wetin I dey tok. Make una open una ear, so dat una go hear wetin I dey tell una,


My God, Yu don rijet us? Yu nor go follow awa sojas go war again?


My God, Yu don rijet and skata awa defence, bikos Yu dey vex for us. But naw, make Yu kom favor us again.


I dey kry dey sey, “My God wey bi my rock, wetin make Yu forget mi? Wetin go make mi dey waka with pains bikos my enemies dey opress mi?”


Smoke dey kom out from dia nose; fire dey pour kom out from dia mout with hot shako.


My God, wetin make Yu stand far from mi? Wetin make Yu dey hide wen I dey trobol?


But Moses beg God kon sey, “My Oga! Why Yu dey vex with yor pipol wey Yu take komot from Egypt with great pawa and mighty hand?


Di tribe wey remain among my pipol, I go forget dem kon give dem to dia enemies wey go beat and tif dia propaty,


Di Almighty One wey bi God don tok; E don gada evribody rite from where di sun for dey raiz go rish where e for dey go down.


En love wey nor dey fail don go forever? E promise don fail finish?


Yu don make us dey chop sorrow like food kon drink tears wey full bucket.


Yu nor go revive us again so dat yor pipol go happy bikos of Yu?


But Oga God, na Yu bi awa papa. Wi bi klay and na Yu mold us. Na Yu kreate us,


Abi Yu don rijet us forever? Yu go kontinue to dey vex for us?


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka