Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 73:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 My body fit fail and my spirit fit weak, but na God dey make my heart strong; na-im bi my own forever.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 73:26
21 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wen I pray, na wons Yu dey ansa mi! Yu enkourage mi kon give mi strent.


Na God bi di rock wey dey protet mi. Na-im dey guide mi and na-im bi di pawa wey dey save mi and I dey save inside am.


I really love to dey di kourt wey dey God temple. My heart and my whole body dey shaut for joy, bikos of God wey dey alive.


Oga, na Yu bi my God and e don tey wen I dey wait for Yu, bikos my soul dey hongry for Yu. My whole body dey hongry for Yu inside dis dry and pash-pash land wey nor get wota.


Den I pray to Yu, my Oga God kon sey, “Na Yu dey guide mi. Na Yu bi evritin wey I really wont for dis life.


I tell mysef sey, “Na only God I get, so I go trust only en.”


So, make yu dey patient, as yu dey wait for God and get strong mind. Yes! Make yu dey patient, as yu dey wait for am.


as I know sey di time wey I go die don near, bikos awa Oga God Jesus Christ don show mi.


Bikos to mi, to dey dis life, na to live for Christ and to die inside Christ, na dat one betta pass.


Na Oga God dey guide and save mi! So I promise to always dey obey yor word!


Trobol gada round mi and I nor fit kount dem! My sins don many well-well and I nor sure sey I go fit dey free from dem! Dem many pass di hair wey dey my head and I don lost all my hope.


Even if E kill mi, I go still dey bilive am; I go still tell am wetin dey do mi!


Di pesin wey win, go inherit dis tins. I go bi en God and e go bi my pikin.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka