Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 72:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 All di pipol wey dey fear God go prosper as di king dey rule. So make goodness follow dem, as long as di moon dey shine for di sky.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 72:7
24 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

E go judge and setol kworel among nashons. E go setol many pipol kase. Dem go turn dia swod to ordinary blade kon use dia spear dey work for vineyard. Den, no nashon go fight against anoda nashon and dem nor go train pipol to fight war again.


But for una wey dey fear my name, my sun wey dey give life go shine and heal una. Una go dey free kon dey happy like melu pikin wey dem open en kage make e for go play.


But doz wey dey fear God, go prosper like bambo tree and dem go strong as dem dey grow like cedar tree for Lebanon.


“Na only God get Glory for heaven and eart, make peace and favor dey with evribody.”


Even una small family wey dey honbol demsef, go dey great like nashon wey get pawa well-well. Wen di time rish, I go make dis tins happen kwik-kwik. Na mi wey bi God, tok am!”


All di pipol wey bilive Jesus Christ kon dey do tins togeda with one mind and nobody sey e go use wetin e get for ensef alone, so dem kon dey share dia propaty togeda.


Na-im go rule Jakob house forever and en kingdom nor go ever end.”


For di time wey dis kings go dey rule, God wey dey heaven go raiz one kind kingdom wey nor go ever end. Dem nor go fit distroy di kingdom and anoda pesin nor go rule am. E go distroy and skata all di oda kingdoms. But dis kingdom go stand forever.


Jerusalem pipol, make una raiz and shine like sun, bikos God glory dey shine on-top una!


Judah and Israel pipol get peace thru-out di time wey Solomon dey rule and all di family get dia own grapevines and fig trees.


But naw, God don give mi peace for evriwhere. I nor get any enemy and I nor dey fear sey pipol go won attack mi.


God sey, “I go remove di shariot from Israel, den take di horse dem komot from Jerusalem and distroy evritin wey dem take dey fight war. Una king go make peace with oda nashons. E go rule from one sea to di oda: Even from Eufrates River go rish where di eart for end.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka