Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 72:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Di King go save poor pipol wen dem kry kom meet am kon help doz wey dem dey opress and doz wey nor get who go fight for dem.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 72:12
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wen poor pipol kry kom meet mi, I dey help dem; I dey help pikin wey nor get papa and mama and doz wey nor get where to go.


Pipol wey dey sofa, E go listin to dia prayers. E nor go rijet dem wen dem dey beg am.


So, di pipol wey Jesus take go meet God, e go save dem for forever and ever, bikos e dey alive to pray for dem.


Den I tink of all di wiked tins wey dey happen for dis world. I si pipol wey dem dey opress, dey kry and nobody dey to help dem. Nobody dey to save dem from doz pawaful men wey dey opress dem.


Oga God, na Yu bi di hope wey poor pipol get. True-true, Yu go hear dia kry kon konfort dem.


Una know di grace wey awa Oga God Jesus Christ get; even doh e dey rish, e kon turn poor man bikos of una, so dat thru en poverty, una go dey rish.


“God Spirit dey my body, bikos E don anoint mi make I prish Good News give poor pipol. E send mi make I prish freedom give pipol wey dey prison and make blind pipol for si. E still sey make I free doz wey dem dey opress


Wen poor pipol and doz wey dem dey opress dey look for wota bikos dia trot don dry, den mi, wey bi God go ansa dem. Israel God nor go ever abandon dem.


E go defend doz wey dem dey opress among di pipol, diliver poor pipol shidren and distroy doz wey dey opress pipol.


So, Jesus ansa dem, make una go tell John wetin una don si and hear: “Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka before, dey waka, pipol wey get leprosy, dia body don klean, pipol wey nor dey hear, don dey hear naw, pipol wey don die, don wake-up and even poor pipol, don hear di Good News.


to hear di prisonas kry for help and to release doz wey dem won kill.


Doz wey dey face trobol or owe pesin or wey nor get wetin to do kon gada follow David and e kon dey lead dem.


I know sey yu go listin to mi kon save mi from di pesin wey dey try to kill mi and my pikin, so dat dem go remove us from di land wey God give en pipol.


But God use sofa take dey tish and save en pipol kon korrect dem with pain.


For morning, aftanoon and nite, I dey kry with pain and God hear my vois.


Good pesin know wetin bi poor pipol own, but wiked pipol nor fit undastand tins like dat.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka