Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 7:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 E go ready en swod wey dey kill kon shot en arrow wey dey hot like fire.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 7:13
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

E good as God dey ponish di pipol wey dey trobol una.


Yu go save yor pipol and di king wey Yu choose. Na Yu kill di pesin wey dey lead wiked pipol kon distroy doz wey dey follow am.


But God go shot dem; na wons en arrows go wound dem and dem go fall.


Yor arrows sharp, e dey shuk yor enemies for dia heart and nashons dey fall for yor leg.


E shot en arrow kon skata en enemies and as en lite flash, dem kon dey konfuse more-more.


Bikos dis pipol kill yor pipol and profets, so yu don give dem blood make dem drink, bikos na wetin good for dem bi dat!”


Dem dey kry with loud vois sey, “Oga God wey get pawa, how long e go take before yu go judge doz wey dey live for dis eart? Make yu ponish dem, bikos na dem kill us!”


As dem si yor arrow dey kom with speed and as yor spear dey shine, di sun and di moon nor fit move komot from where dem dey.


Make Yu shine yor lite kon skata yor enemies! Make Yu shot yor arrow kon konfuse dem!


Dem don sharp dia tongue like swod kon ready to shot dia betta words wey bi like arrows.


bikos wiked pipol dey wound innocent pipol anyhow. Dem hide for darkness dey shot good pipol with dia bow and arrow.


God arrow don enter my body and dia poizin dey flow inside my spirit. God don make mi dey fear.


I go make my arrow full with blood and my swod go distroy pipol flesh, doz pipol wey I katch and kill and even di enemies oga blood!’ ”


I go inkrease dia wahala, I go use all my arrow for dia body.


I go make my lite sharp like swod and my hand go hold di judgement swod well-well; I go revensh doz wey make mi vex kon pay doz wey hate mi!


E set arrow kon shot us like sey wi bi en enemies. Yes, en rite hand dey ready to shot. E kill us with awa strong men kon pour en vexnashon like fire for Zion head.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka