Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 69:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 My God, make Yu save mi, bikos di wota don almost kover mi.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 69:1
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wen una dey pass thru deep wota, I go dey with una. Una go fit handle any wahala wey kom una way. Wen una pass thru fire, e nor go burn una. Di temptashon wey go kom, nor go too hard for una.


Dem dey pour wota put for my head and I tink sey na die I dey.


Den di angel kon tell mi, “Di wota wey yu si, wey di ashawo sidan on-top, na many pipol, tribe, kountry and language.


Na justice dem go take measure di foundashon. And na trut dem go take build am.” Big-big stones go fall kon kill all di pipol wey dey lie well-well and wota go distroy all di place where dem tink sey dem dey save.


I dey sink enter mud; di place wey di groun soft well-well. I dey for deep wota and di wota dey karry mi go.


My God, Yu don rijet and skata awa defence, bikos Yu dey vex for us. But naw, make Yu kom favor us again.


Na betta words full my heart for di king and I go use my vois praiz am, just as dem dey use biro rite for book.


I dey hear and si as wave for sea dey jam demsef! Yor wave and breeze dey make my heart shake.


So make evribody wey dey fear God pray to am as time still dey, so dat dem nor go sofa for judgement day.


Deat dey round mi and trobol won kill mi;


Di Shepad for Israel, make Yu listin to us. Yu wey dey kare for Josef shidren-shidren, just as shepad dey kare for en sheep. My God wey high pass di angels, make Yu show yor glory wey dey shine


Yu nor dey si again, bikos di trobol don too dark for yor eye and wota don kover yu.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka