Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 68:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 But pipol wey dey fear God go dey happy; dem dey happy for God present and dia joy nor dey end.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 68:3
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Pipol wey dey fear God go happy, bikos of God and dem go dey save inside am. So make evribody wey dey do wetin dey rite, praiz God.


Make wi happy well-well kon gi-am glory, bikos di Lamb marriage don rish and di pesin wey E won marry, don ready too.”


Evribody wey dey heaven, God pipol, di apostles and profets, make una happy bikos God don judge and kondemn am bikos of una!”


So make evribody wey dey fear God, happy kon praiz en holy name!


Aldo una neva si am, but una love am. Una nor dey si am naw, but una bilive am, una get happiness and glory wey una nor go fit esplain.


Pipol wey dey fear God go happy wen dem si wiked pipol dey fall. Dem go use wiked pipol blood take wosh dia legs.


For der, I go-go God altar; di God wey dey give mi joy kon praiz am with my harp!


My God, si as di king dey rijoice, bikos of yor pawa! E dey happy and shaut, bikos Yu make am win.


For der, una must celebrate for di Oga una God present, with all una shidren, savants and Levi shidren wey dey stay una town, (bikos dem nor get land or propaty among una).


So, doz of una wey get pure heart and dey raitious, make una happy well-well!


But wiked pipol go die, bikos God enemies bi like flower for field wey go soon vanish like smoke.


I don warn proud pipol sey, ‘Make dem stop to dey make mout!’ kon tell wiked pipol sey, ‘Make una nor dey happy sey una don win!


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka