Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 68:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Make God raiz-up! Make all en enemies skata! Make all di pipol wey hate am, run as dem si am.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 68:1
21 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

And wen dem karry di box dey travel, Moses go sey, “My God! Arise make yor enemies dem skata and make all doz wey hate Yu, run as dem si Yu dey kom.”


So my God, make Yu kom help us! Save us bikos of yor love wey nor dey fail.


Yu distroy and kill Rahab and Yu skata all yor enemies with yor mighty hand.


Wen Yu fight for us, nashons dey run! Wen dem hear yor nois, dem dey run skata.


My Oga God, make Yu and di box wey dey show as yor pawa bi, enter and stay dis temple forever! Make yor priests si as Yu dey diliver pipol! Make doz wey dey obey Yu happy for di blessings and propaty wey Yu dey give!


Make Yu ponish dat wiked animal wey dey wota and di nashons wey dey follow am, until dem go honbol demsef kon offa gold and silva give Yu. Make Yu skata doz pipol wey like war.


Wen God wey get pawa skata kings, dem dey melt like snow for Mount Zalmon!


Make Yu nor kill dem just like dat, bikos my pipol go kwik forget di lesin. So, make Yu use yor pawa take make dem dey waka up-and-down without house, den make Yu honbol dem, bikos na Yu my God, dey protet mi.


Di king go katch all en enemies. E go seize evribody wey hate am with en strong rite hand.


But E nor dey waste time to ponish and distroy doz wey rijet am.


Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.


Den all di iron, gold, silva and bronze kon bi like san-san for dry sizin. Breeze blow kon karry all of dem go and dem nor si dem again. But di stone wey skata di image, grow turn to mountin kon kover di eart.


Burn di third part for fire afta yor work don finish. Take anoda part kon kut am anyhow for outside di town. Den make yu skata di remainin part for air and I go use my swod take distroy dem.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka