Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 67:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Make God show us en favor and bless us! Make E always dey happy with us!

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 67:1
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Many pipol dey sey, “Who go fit show us wetin dey good?” So my God, make Yu smile for us.


Bikos God wey sey, “Make lite shine from darkness,” Na-im dey shine inside awa heart, so dat E go give us di lite wey show us en glory wey dey Christ face.


My God, make Yu ansa mi wen I koll Yu. Na only Yu go fit diliver and free mi from wiked pipol and all my trobol. Make Yu sorry for mi kon hear my prayers.


Make Yu look mi with love kon tish mi yor laws.


Make yor favor shine on yor savant. Make Yu save mi with yor love wey nor dey fail.


Awa God, di warrior wey nobody dey si, make Yu give us life again! Make Yu just smile for us and wi go dey save!


My Oga wey bi God for Heaven Sojas, make Yu bring us back to yorsef again. Make yor face shine upon us again and na only den wi go get rest of mind.


I bless God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa; wey don bless us with difren spiritual blessing from heaven, bikos of Christ.


Make di grace wey awa Oga God Jesus Christ give us and di love wey God get for us, plus di Holy Spirit fellowship, dey with una.


So God, make Yu save yor pipol! Make Yu bless Israel pipol wey bi yor special propaty. Make Yu guide dem like shepad kon karry dem for yor hand forever.


So God go forgive en pipol Israel wey E save and E nor go ponish dem sey na dem kill pesin wey nor do anytin.” Den di sin nor go dey dia head at-all.


My God, make Yu nor drive mi, bikos Yu dey vex. Nor ponish mi with yor vexnashon.


God don show ensef to Judah pipol. En name dey great among Israel pipol.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka