Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 64:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Dem dey enkourage each oda to do wiked tins and dey plan how to set trap for sekret kon dey make mout sey, “Nobody go ever know or si us!”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 64:5
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Proud pipol don set trap to katch mi; dem spread dia net and dia trap dey evriwhere for di road.


Wiked pipol dey sey, “God nor dey si us! E don klose en eye and E nor go even fit si wetin wi dey do!”


God kon ask mi, “Man pikin, yu si wetin Israel leaders dey hide do? All of dem dey woship for one room wey juju full. Dem dey sey, ‘God nor dey si us! E don leave dis land.’ ”


Dem sey, “God nor dey si us! Israel God nor even kare about wetin dey happen.”


Make Yu listin to how dem dey curse mi and even for publik, dem dey treaten to kill mi dey sey, “Afta wi don finish with yu, nobody go shalenge us!”


But yu still ask, ‘Wetin God know? How E won take judge us thru dis tick darkness?’


Dem dey enkourage and tell each oda sey, ‘My broda, nor fear; make yor heart strong.’


Wi don eskape like bird wey komot from hunta trap. Dia trap and net wey dem set for us, don break and wi don dey free!


So, I beg make yu kom help mi curse dis nashon, bikos dem too get pawa pass mi. May bi I go defeat and drive dem komot from di land. Bikos I know sey anybody wey yu bless, blessing go follow am and anybody wey yu curse, curse go follow am.”


Di enemies sey, ‘I go porshu, katch, divide dia propaty kon take evritin wey I wont. I go distroy dem with my swod.’


Sinnas go dey happy bikos of dem and dem go dey give gift to each oda to celebrate di two profet deat, bikos di profets trobol dem well-well.


“E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey travel go evriwhere just to win one pesin kon meet God and afta una don win am, una go kon make am bad well-well like devil pikin, pass as una bi!


wen God take mi komot from my papa house and I kon tell Sarah sey, ‘Anywhere wi go, di only tin wey yu go do to show sey yu love mi, na to tell dem sey I bi yor broda.’ ”


Israel pipol enkourage each oda kon stay for di same place where dem for fight before.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka