4 But Yu don give one banner to pipol wey dey fear Yu, so dat dem go dey save wen enemies attack dem.
Make wi shaut for joy wen wi hear viktory sound kon raiz awa banner wey dey show awa God name. Make God ansa all awa prayers.
God go raiz flag as sign for di pipol; E go gada dem togeda again with all en pipol wey skata for evriwhere for di eart.
So Moses build one altar kon koll am, “Na di Oga God bi my banner,”
Make yu go on-top di hill go raiz di war flag! Make yu shaut and wave yor hand, so dat di sojas go fit enter di prince gate.
God dey use sign take koll pipol from far-far nashon. E dey blow trumpet take koll dem from evriwhere for di world and dem dey gada kom kwik-kwik.
E take mi go di party kon show mi as e love mi rish.
Awa Oga God tell en pipol sey, “Si, I go lift my hand to di nashon kon tell di pipol my laws; dem go karry una shidren kom with dia hand kon put una dotas for dia shoulder.
From east go rish west, evribody go fear en and en great pawa. E go kom like river wey dey rush well-well and like strong breeze wey dey blow.
Make yu appear with yor majesty kon ride go defend wetin dey rite, true and good. Dat time, Yu go win yor enemies with yor strong rite hand.