“Di king go tell di pipol wey dey en left hand, ‘Make una komot from my side, una wey God don curse! Make una enter hell-fire wey dem prepare for devil and en wiked angels.
Una go stay for Zion! Jerusalem pipol nor go kry again. Wen God hear as una dey kry with pain, E go kom save and help una. Yes! E go ansa wen una kry for help.
“Go back go meet King Hezekaya kon tell am, ‘Mi wey bi yor papa David God don hear yor prayer and si yor tears; so I go let yu stay for anoda fifteen years.