Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 6:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 I don taya to komplain, bikos evry nite, I dey wet my bed with wota from my eyes.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 6:6
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I don taya to dey shaut for help; sore dey my trot naw and my eye don taya to dey look for my God.


I dey kry both day and nite and na tears bi di only food wey I dey chop and my enemies dey tell mi sey, “Where dat yor God dey sef?”


So, Oga God, I know sey Yu know wetin I wont. Yu dey hear as I dey kry with pain.


I don kry sotey wota nor gri kom out from my eye again; my heart don break. I don taya and e dey pain bi wen I si how dem distroy my pipol and how shidren dey faint anyhow for di town.


Bikos of dis tins; I kry well-well, but nobody dey to konfort or give mi hope. My shidren nor get future, bikos awa enemies don win us.


Jerusalem pipol dey kry well-well for nite. Doz wey love am nor dey again to konfort am and all en friends don lie for en head; dem don turn en enemy.


“Today, my komplain still dey make my heart betta; I nor fit hold my bitterness.


My friends dey tok against mi and I dey kry give God.


Mont to mont, I nor get anytin to live for; evry nite dey kause pain for mi.


E knee down for Jesus front dey kry and e kon dey wet Jesus leg with di tears from en eye. E klean Jesus leg with en hair kon kiss dem, den e pour di oil put.


God sey make I tell di pipol dis word: “I dey kry both day and nite and nor-tin fit stop mi, bikos my pipol don wound and dia sore deep well-well.


My own tears don blind my eyes. My God, evriday I dey beg make Yu kom help mi; I lift my hand to Yu make Yu sorry for mi.


My God, make Yu hear my prayers! Make Yu listin to my kry for help! Make Yu dey look di tears from my eye. I bi like pesin wey travel kom stay with Yu, just as my grand-grand papa dem bi to Yu.


“Life don taya mi; so make Yu hear as I dey tok how my heart betta rish.


My Oga God, make Yu hear mi kon sorry for mi. Make Yu kom help mi.”


Pipol wey dey grave go fit tok about yor love wey nor dey fail? For where dem dey naw, dem go fit tok about how Yu good rish?


Pipol wey don die nor fit sing praiz God, bikos dem don die enter dia grave wey kwayet.


Nobody wey don die go fit praiz Yu. Pipol wey don die nor go fit know how Yu good rish.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka