Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 59:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Make Yu listin to how dem dey curse mi and even for publik, dem dey treaten to kill mi dey sey, “Afta wi don finish with yu, nobody go shalenge us!”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 59:7
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na lions gada round mi so! I dey with pipol wey won kill mi; pipol wey dia tit sharp like spear and arrow and wey dia words dey kut like swods.


Wen wise pipol tok, pipol dey undastand well, but na only yeye words dey kom out from foolish pipol mout.


Wiked pipol dey sey, “God nor dey si us! E don klose en eye and E nor go even fit si wetin wi dey do!”


Dem dey ask, “How God won take know wetin wi dey do? Di Most High even know wetin dey happen so o-o?”


Doz wey dey fear God, dey tink before dem tok; but na only evil words full wiked pipol mout.


Foolish pipol dey tok anyhow, but wetin wise pipol tok, dey heal many wound.


Dia words dey smooth like butter, but dia heart strong like stone. Dia word smooth well-well like pomade, but na dagger dey under dia tongue!


Why wiked pipol dey go free sef, even wen dem nor respet God? Dem dey sey, “God nor go ever ask us sey wetin wi do.”


Una, snake shidren! How una won take tok good word since una dey wiked? Na wetin full pesin heart, naim en mout dey tok.


“Yu si as pipol dey sey I don rijet Israel and Judah pipol; di two family wey I choose? Na dis make dem nor dey respet my pipol at-all, bikos dem nor si dem as strong nashon again.


How long dem go dey tok anyhow? Na how long dis wiked pipol go dey make mout?


Evriday, my enemies dey tok as dem dey plan against mi.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka