Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 59:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Make Yu nor kill dem just like dat, bikos my pipol go kwik forget di lesin. So, make Yu use yor pawa take make dem dey waka up-and-down without house, den make Yu honbol dem, bikos na Yu my God, dey protet mi.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 59:11
22 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But Yu, my God, na Yu bi di wall wey dey protet mi; na Yu bi my glory and di pesin wey make mi dey alive.


For dat time, pipol go look for deat, but dem nor go si am. Dem go won die, but deat go run from dem.


So, make di pipol wey dey Judea run go mountin and doz wey dey inside town must komot der. Make doz wey dey outside, nor enter di town again,


But God go distroy yu wons and for all. E go remove yu from yor house kon distroy yu from dis world.


Yes! Look dem, make yu bring dem kom down kon skata where wiked pipol stand put.


bikos God go skata una among many kountries from one end for di eart go rish di oda end. For der, una go woship gods wey una or una grand-grand papa nor know before; gods wey dem make with wood and stones!


God go skata una among di pipol and una nor go many for di kountries wey God go drive una go.


kon skata dia shidren-shidren among di nashons and for far-far place.


Oga God na awa sun and naim dey protet us. God dey give us grace and glory and E go always dey good to doz wey dey do good.


My God, make Yu favor di king wey dey guide us! Make Yu favor di one wey Yu anoint.


Yu don busher us give dem like animal wey dem won chop kon skata us among di nashons.


But make una look well! Make una dey kareful, so dat una nor go forget wetin una don take una eyes si. As long as una dey life, make una nor let dis tins komot from una mind! Make una make sure sey una tell una shidren and grand-shidren about dis tins.


I go make war happen to una and I go skata una go strenj land. Nobody go dey di land and I go distroy una towns.


Pipol wey dey alive naw, know sey one day dem go die, but pipol wey don die, nor know anytin and dem nor get any reward again; pipol nor dey remember dem again.


Leta, David mind kon dey judge am, bikos e kut Saul klot,


Yes, God dey my side; E go help mi. I go dey happy, bikos I don win di pipol wey hate mi.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka