1 My God, make Yu save mi from my enemies. Make Yu protet mi from di pipol wey won kill mi.
kon save mi from my enemies. E keep mi for where my enemies nor go for fit tosh mi kon save mi from wiked pipol.
My God, make Yu sorry for mi. Abeg, sorry for mi, bikos na Yu dey protet mi. I go hide under yor shadow until I don free from all dis wahala.
na-im go dey save like kountry wey dem protet well-well. E go get food and wota to chop and drink.
Oga God, make Yu save mi from my enemies; bikos I run kom meet Yu make Yu hide mi.
My God, save mi from wiked pipol pawa and from doz wey dey opress mi,
Use yor love wey nor dey fail, take silent all my enemies kon distroy dem, bikos I bi yor savant.
God sey, “I go save pipol wey love mi. I go protet doz wey trust my name.
Wen yu dey for trobol, make God ansa yor kry for help. Make Jakob God name, save yu from all wahala.
So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.”
Una wey dey rule, una dey judge well? Una dey judge di pipol well so?