9 I go tank Yu wey bi my God for where evribody dey. I go sing yor praiz among all di nashons.
Make una rite di wonderful tins wey E do among di nashons. Make una tell evribody about di good-good tins wey E do.
Bikos of dis, I go praiz God among di nashons; I go sing praiz to en name.
My God, I tank Yu with all my heart; I go sing yor praiz for where evry oda gods dey.
Wetin make pipol wey dey dis world dey vex? Wetin make dem dey make plans wey go fail?
so dat Gentile pipol go praiz God sey e dey good to dem. Just as God word sey, “I go tell Gentile pipol about yu and I go sing, dey praiz yor name.”
Deborah, make yu wake-up! Deborah, I sey make yu wake-up! Make yu wake-up kon sing song! Barak wey bi Abinoam pikin, make yu stand up go free doz wey dey prison.
For der, I go-go God altar; di God wey dey give mi joy kon praiz am with my harp!