Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 56:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Evriday, dem dey kause wahala for mi. All wetin dem sabi, na to dey plan bad tins against mi.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 56:5
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

and dem kon dey plan, so dat dem go fit find word for en mout, wey dem go take hold am.


Den di Farisee pipol komot go plan how dem go take katch Jesus with wetin e go tok.


Pipol wey hate mi dey tok for each oda ear about mi and na only bad tins dem dey tink about mi.


E tok about dis tins for all en letas. Aldo some tins for di leta dey hard to undastand and doz wey nor know di trut or dey stabol, don turn dem to wetin go kill dem. Na so dem take distroy all di oda part for God word too.


Saul kon sey, “I go give Mikal to David, so dat Mikal go bi trap for am and Filistia pipol go kill-am.” So Saul tell David, “Today, na di sekond time for yu to bi my in-law.”


Jesus ansa dem, “Even if una distroy dis Temple, for three days time, I go build am again.”


Den Saul tell David, “Na my senior girl bi dis, en name na Merab. I wont make yu marry am. I just wont make yu dey strong for mi and fight God war.” Bikos Saul tink sey, “No nid for mi to kill-am, make Filistia pipol kill-am!”


kon sey, “Dis man sey, ‘I go fit distroy God Temple and build am again for three days’.”


Den di pipol sey, “Make una kom, make wi do sometin about dis Jeremaya! Wi go always get priest wey go dey to tell us wetin wi go do; wise pipol go dey wey go advise us and wi go always get profet wey go prish God word give us. So make wi lie against am kon stop to listin to anytin wey e tok.”


e kon dey fear David more-more and from dat day go, Saul kon hate David more-more.


Den Saul trow en spear face Jonatan, so dat e go pin am for groun. Den Jonatan kon know sey en papa won kill David.


If yor papa kon sey, ‘No wahala,’ den make yu know sey I dey save. But if e vex, make yu know sey e won kill mi.


So Elijah go meet King Ahab. Dat time, e nor dey eazy to plant food for Samaria.


Dem bilive dia money kon dey boast with all di tins wey dem get.


God dey my side, so I nor go fear. So wetin ordinary pesin fit do mi?


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka