12 My God, I go do wetin I vow to give Yu and tank Yu, bikos of how Yu dey help mi.
So make tanksgivin bi una sakrifice to God, den make una keep di promise wey una make to di Most High.
I don first promise and I dey promise again sey; I go always dey obey all yor kommandment.
So, wen una vow give di Oga una God, make una keep una promise. Make evribody bring gift kon give di Holy One!
My God, make Yu raiz-up with all yor pawa and wi go praiz and sing songs to take celebrate evritin wey Yu don do.
So e kon promise God sey, “My papa, if Yu go sorry and remember mi, yor savant, den give mi one boy pikin, I go dedikate am give Yu as long as e dey for dis life and dem nor go ever kut en hair.”
For dat time yu go sey: “Oga God, I praiz Yu, bikos Yu bin dey vex for mi, but naw, Yu dey konfort mi and Yu nor dey vex again.
God dey my side, so I nor go fear. So wetin ordinary pesin fit do mi?