4 My heart dey beat for my chest and bikos of deat, I kon dey fear.
bikos deat kover mi like klot and di fear to die go grave, dey make mi shake. Na only sorrow and trobol I dey si.
Wen Jesus still dey dis eart, e pray and kry to God wey go save am from deat. God hear en prayers, bikos e obey God for evritin.
bikos na so-so trobol full my life and deat don near mi well-well.
Dia curse dey pain and e dey make my heart kut; I dey look for who go tell mi sorry, but I nor si. I dey find who go konfort mi, but I still nor si anybody.
I dey fear well-well. Na how e go tey rish, before Yu go kon save mi?
“My heart heavy well-well. Wetin I go tok? ‘Papa, make yu save mi from dis tin wey won happen’? No! Na dis tin make mi kom dis world.
Shimei curse am dey sey, “Make yu get out! I sey make yu dey go! Yu wey kill pipol! Wiked man!
Dia wahala don break my bones. Dem dey laf dey sey, “Where dat yor God dey sef?”