6 I go just give Yu sakrifice on my own! My Oga God, I go praiz yor name, bikos e dey good and
My God, I go praiz yu forever, bikos of di tins wey yu don do. I go always dey trust Yu, bikos pipol wey dey obey Yu, know sey Yu dey good.
Make wi praiz God! Si as e dey good to sing praiz God! Yes, na to praiz God bi di rite tin to do!
So, I go tank God, bikos E dey judge well; I go sing and praiz di Most High God.
True-true, pipol wey dey do wetin dey rite, dey praiz yor name and doz wey dey fear God, go stay for en present.
Make dem tank am with sakrifice kon sing about di tins wey E do.
So I go tank God with sakrifice kon pray to am.
E dey good to tank God. Yes! Awa belle dey sweet us wen ever wi dey sing and praiz di Most High God.
My God, make Yu raiz-up with all yor pawa and wi go praiz and sing songs to take celebrate evritin wey Yu don do.
So make tanksgivin bi una sakrifice to God, den make una keep di promise wey una make to di Most High.
Yes, God dey my side; E go help mi. I go dey happy, bikos I don win di pipol wey hate mi.
But dia curse nor dey pain mi and bikos God wey get pawa dey help mi, I dey fit bear dem. I know sey dem nor go fit disgrace mi,
Na God wey get pawa, help mi, so who go fit sey I dey guilty? All di pipol wey dey akuiz mi go disappear, dem go vanish like klot wey dey fade.