Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 54:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Make evry wiked plan wey my enemies dey plan, turn back go meet dem.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 54:5
11 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Use yor love wey nor dey fail, take silent all my enemies kon distroy dem, bikos I bi yor savant.


So my God, where all di good tins wey Yu bin do for us; di ones wey Yu do just as Yu promise David?


So God go pay evil and wiked pipol back, E go distroy dem, bikos of dia sins. True-true, di Oga awa God go distroy dem.


All of una wey dey fear and obey God, make una love am! Bikos God dey protet pipol wey dey loyal to am, but E dey vex ponish doz wey dey do wiked tins.


My God, make Yu tish mi how I go live my life and bikos my enemies hide for korna dey wait to distroy mi, make Yu lead mi pass di rite road.


Make yu pay am as e take pay odas; pay am doubol for wetin e do. For di wine cup wey e mix, make yu mix doubol for am.


Alexanda wey dey do iron work, wiked mi well-well, but Christ go judge am for wetin e do.


Babilon pipol! God go soon distroy una. Di pesin wey go pay una back for wetin una don do to us, make happiness bi en own.


My God, make Yu save mi as Yu dey lead mi, bikos my enemies dey korna dey wait to katch mi. Make Yu remove all di problem wey dey di road wey Yu dey take mi pass,


My God, make Yu hear my prayers; make Yu listin as I dey pray! Make Yu ansa mi, bikos Yu dey good and evritin wey Yu dey do, dey rite.


My God, wiked pipol dey raiz against mi; sturbon pipol dey won kill mi. Yu nor mean anytin to dem!


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka