Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 54:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 But na God dey help mi. Na God dey keep my life!

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 54:4
10 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So make wi get mind wey go make us fit sey, “Na God bi my helpa, so wi nor go fear. Wetin human being go fit do us?”


So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.


My enemies try well-well to kill mi, but di Oga my God save mi.


Wetin wi go tok about all dis tins? If God dey for awa side, who go fit dey against us?


God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.


Den one spirit enter Amasai wey dey lead Di Thirty, so e kon sey, “David, Jesse pikin, wi dey yor side! E go betta for yu! E go betta for doz wey dey help yu! True-true, yor God dey yor side!” So David welkom dem kon make dem ofisas among en sojas.


Instead, Yu don keep my life, bikos I dey innocent; Yu don let mi enter yor present forever.


My Oga God, make Yu hear my kry for help, den judge my kase. Listin to my prayer, bikos na trut I dey tok.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka