6 Doz wey dey do wetin dey rite, go si am kon happy. Dem go laf dey sey,
Good pipol dey happy and doz wey dia belle klean, dey laf.
E don give mi new song to sing and hymns wey I go take praiz awa Oga God. Many pipol go si wetin E do kon praiz am, den dem go start to trust God.
So make yu put yor hope for Oga God. Make yu dey always waka for en ways and E go honor yu wen E give yu dis land, den yu go si as E dey distroy wiked pipol.
Evribody wey dey heaven, God pipol, di apostles and profets, make una happy bikos God don judge and kondemn am bikos of una!”
Na who nor go fear and praiz yor name? Bikos na only yu dey holy. Pipol for evriwhere go kom woship yu, bikos dem dey si di good tins wey yu dey do.”
“God sey, ‘Jerusalem town dey laf and play with King Sennakerib.
I dey shake bikos I dey fear Yu and yor kommandments and rules dey make mi sopraiz.
Jerusalem pipol and all di towns for Judah don hear about am and dem dey happy, bikos of how God dey judge pipol!
Den evribody go dey fear and dem go tok about di mighty and wonderful tins wey God don do.
Wen una si all dis tins dey happen, una go sey, “God pawa big well-well both for Israel land and for evriwhere for di world!”
My God, make Yu save mi from pipol wey dey lie and deceive odas.
Trut go last forever, but lie-lie nor dey tey before evribody go know sey na lie.