Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 51:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 I know sey I do many bad tins; bikos I really know all di sins wey I dey kommit.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 51:3
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Oga God, di bad tins wey wi do against Yu, plenty well-well. Awa sins dey fight us and wi know sey na so e bi.


Yu nor go ever susid for life if yu try to hide yor sin. Konfess and stop to do dem and God go show yu mesi.


But naw, I dey konfess my sins; I really dey sorry for evritin wey I don do.


So, I konfess all my sins kon stop to hide all di bad tins wey I dey do. I tell mysef sey, “I go konfess my sins to God.” And E really forgive mi!


So make wi liedan with shame! Make awa disgrace kover us. Wi and awa grand-grand papa don sin against di Oga awa God. Since wi dey yong kon rish naw, wi nor gri obey di Oga awa God.”


Trobol gada round mi and I nor fit kount dem! My sins don many well-well and I nor sure sey I go fit dey free from dem! Dem many pass di hair wey dey my head and I don lost all my hope.


Di pesin go sing give odas sey, ‘I sin kon do wetin dey bad, but God nor ponish mi as e suppose to bi.’


Dem don already separate demsef from all di strenjas. Dem wear sak klot kon pak dust for dia head as sign sey dem dey sorry. Den dem kon stand dey konfess dia sins wey dem and dia grand-grand papa don kommit.


Na only bad-bad tins my enemies dey tok about mi. Dem dey ask, “Wen e go take die make pipol forget am?”


But na mi wey bi God still dey forgive una sins and I do all dis tins, bikos of who I bi! I nor go kount una sins against una.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka