Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 51:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Den I go tish wiked pipol yor ways and dem go turn kom meet Yu.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 51:13
24 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But Simon, I don pray for yu make yor faith nor for fail. Wen yu don turn back kom meet God, make yu help yor brodas too.”


So di church send dem go and as dem dey go, dem pass Foenicia and Samaria kon tell pipol wey dem meet for der how Gentile pipol take turn from dia sin kom meet God and di story make all di brodas wey hear am, happy well-well.


So make una turn from sin kom meet God, make E for forgive una,


den e ansa, “I tell una true word, unless una bi like small pikin, una nor go fit enter God Kingdom!


I hear Israel pipol dey tok with pain sey, “Oga God! Wi bi like animal wey dem nor train, but Yu don tish us to dey obey. So make Yu bring us kom back, bikos wi dey ready to kom meet Yu di Oga wey bi awa God.


Den E tell mi, “Go make dis pipol get strong heart, deaf dia ear and blind dia eyes, so dat dem nor go si, hear or undastand again. If dem bi like dat, dem go turn kom meet mi and I go heal dem.”


and pipol go dey sey, “Make wi klimb go God mountin. Yes! Make wi go Israel God Temple, den E go tish us wetin E wont make wi do and wi go waka for di road wey E choose. Bikos betta tishing dey kom from Jerusalem and God dey tok to en pipol from Zion.


So, I konfess all my sins kon stop to hide all di bad tins wey I dey do. I tell mysef sey, “I go konfess my sins to God.” And E really forgive mi!


God dey good and E dey do wetin dey rite; E dey show di rite road to pipol wey dey waka lost.


Di whole eart go know God kon run go meet am. Evribody for di world go bow woship am.


God laws dey korrect and e dey save life. Di laws wey God give us na trut and dem dey give wisdom to pipol wey ready to learn.


kon tell am, “Yu devil pikin wey nor like good tin, na so-so wayo and bad tins yu sabi do, yu nor go stop to dey oppoz God?


My God, make Yu show mi di rite way kon point di road wey I go follow.


So, bikos God dey vex for Israel pipol, E kon rijet dem; but Judah tribe still dey obey am.


So God rijet all Jakob shidren-shidren; E disgrace and give dem to tif, until E komot all of dem from en present.


So God rijet Israel pipol, just as E don bin warn dem thru all en savant, di profets. Dem karry Israel pipol from dia land go Assyria and dem dey der till naw.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka