Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 50:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 All of una wey don forget mi, make una turn from sin kom meet mi or I go kill una finish and nobody go kom help una.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 50:22
21 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Pipol wey nor dey fear God bi like di reed; dia hope don go as dem just forget God.


Wiked pipol go die enter grave. Dis na wetin go happen to all di pipol wey rijet God.


My pipol don die finish bikos dem nor know mi. Since di priests don rijet mi, misef go rijet dem as my priests. Since una don forget una Oga God laws, misef go forget to bless una shidren.


If Yu nor save mi, dem go chop mi like sey dem bi lion and nobody go fit save mi.


I go attack una like bear wey en pikin lost kon tear una to pieces. As lion and wiked animals dey distroy tins, na so too I go distroy una.


Yong woman dey forget to wear en gold ring? Abi woman wey won marry, dey forget to wear en marriage klot? But e don tey wey my pipol don forget mi.


Dem don forget di Rock wey bi dia papa and di God wey kreate dem, nor dey dia mind again.


Even doz wey dey run fast nor go fit eskape; strong men nor go get pawa again and sojas nor go fit save dia own life.


Una don forget God wey make una; di Pesin wey stresh heaven kon make di eart foundashon? Why una dey always fear pipol wey dey opress una; doz wey ready to distroy una? But naw, una nor go fear dem again.


Wiked pipol too sturbon and dem dey always tink sey, “God nor go do mi anytin, bikos E nor kare.”


Dem dey look for help, but nobody dey to save dem. Dem koll God, but E nor ansa dem.


“But wen en eye klear, e kon sey, ‘All my papa workers get food wey dem nor fit chop finish, but hongry don nearly kill mi for here!


Naw dis na wetin Oga God wey get pawa dey tok: “Make una tink about wetin dey happen to una!


bikos e si sey wetin e dey do nor good, so e kon stop to dey sin. E nor go die at-all, but e go live.


Doz wey remain for Israel go skata go oda nashons and dem go bi like lion among animals for bush; like yong lion wey dey mash and kill oda animals without who go save dem.


I go attack Israel and Judah pipol like lion. Mi mysef go tear dem to pieces kon karry dem komot der and nobody go fit save dem.


Wen God give yu money, make yu tank God and enjoy am, but wen sofa kom, make yu know sey e still kom from God too, bikos nobody go fit tok how tumoro go bi.


God sey, “Na Mi, bi Mi! And e nor get any oda god escept Mi. I dey kill and give life, I dey make pesin sick and heal pesin too and nobody go fit fight mi.


Even doh Yu know sey I nor dey guilty, e nor get who fit save mi from yor hand.


But God nor go forget doz wey dey kry for help. E nor go live dem forever; E go always dey give poor pipol hope.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka