Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 50:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Wen una si tifs, una go hail and klap for dem and una dey spend una time with pesin wey dey sleep with who e nor marry.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 50:18
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make yu nor hurry to make pesin leader and nor rush put hand for en head, so dat yu nor go karry anoda pesin sin for yor head. Make yu keep yorsef pure.


Aldo dem know sey God law sey, pipol wey dey live like dat go die, yet dem nor only dey do dis tins, but dem even dey support pipol wey dey do am.


Make evribody respet marriage: una must make sure sey una nor sleep with who nor bi una husband or wife, bikos God go judge pipol wey dey sleep with who dem nor marry and pipol wey don marry, wey dey sleep with oda pipol.


And una sey, ‘If to sey wi dey alive for awa grand-grand papa time, wi nor for help dem wen dem dey kill di profets.’


Dia hand dey only like to do bad tins! Doz wey bi ofisas and judge, na only bribe dem wont. Doz wey get pawa, dey use am get wetin dem wont.


Dem dey free pipol wey dey guilty kon opress doz wey dey innocent, bikos dem don take bribe.


If anybody sleep with en neighbour wife, dem must kill both di man and di woman.


Jonadab tell am, “Make yu do like sey yu nor well kon go liedan for bed. If yor papa kom si yu, den yu go tell am sey, ‘Abeg, make yu tell Tamar my sista sey make e kom give mi food. I wont make e make di food for here where I go dey si am, den serve mi by ensef.’ ”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka