Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 5:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 My God, true-true, Yu dey reward doz wey dey fear Yu. Yu dey always protet dem well-well, bikos of yor favor wey nor dey end.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 5:12
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Oga God na awa sun and naim dey protet us. God dey give us grace and glory and E go always dey good to doz wey dey do good.


Plenty trobol dey kom meet wiked pipol, but di love wey nor dey fail, dey kover doz wey trust God.


E go bless di pipol wey dey obey am; both small and big.


Make wi praiz God! Pesin wey dey obey and love to do wetin God kommand, blessing dey follow am.


Na God bi di place where I dey hide put and E dey protet mi from trobol. God surround mi with song and happiness from doz wey E diliver.


Na God dey give en pipol strent and na en dey bless dem with peace.


But Yu, my God, na Yu bi di wall wey dey protet mi; na Yu bi my glory and di pesin wey make mi dey alive.


Viktory dey kom from God. So, I dey beg Yu, God sey, make Yu bless yor pipol.


So, make una sing to God! Make una sing praiz en name! Make una praiz di Pesin wey dey ride on-top kloud! Na God bi en name! Make una happy for en present!


Na songs for joy and viktory dem dey sing for di kamp of pipol wey dey fear and obey God, bikos God don do wonderful tins with en strong rite hand!


Make Yu kom show mi yor mesi, just as Yu dey do to evribody wey love yor name.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka