Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 5:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 But make doz wey Yu dey guide, always dey happy! Make dem always dey shaut for joy! Guide dem, so dat doz wey loyal to Yu, go happy!

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 5:11
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

And wi know sey evritin dey work for awa good, bikos wi love God and dey do wetin E wont.


But pipol wey dey fear God go dey happy; dem dey happy for God present and dia joy nor dey end.


But pipol wey dey find Yu, make joy and gladness full dia heart. Make doz wey love yor salvashon always dey shaut sey, “God dey great!”


Di pesin wey fit bear wen problem kom meet am, make e happy, bikos e don show sey en faith strong and e go get di crown wey get life, wey God don promise sey E go give pipol wey love am.


But God word sey, “No eye don ever si; no ear don hear, even pesin mind nor fit tink about di tins wey God don prepare for pipol wey love am.”


Evribody wey dey heaven, God pipol, di apostles and profets, make una happy bikos God don judge and kondemn am bikos of una!”


My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?


Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.


Make una dey respet God well-well or E go fit vex kon distroy una at wons, bikos of di way una dey bihave. But na blessing dey follow doz wey si am as dia Oga God!


En savant shidren-shidren go inherit am and pipol wey dey loyal to am go stay der.


Na animals full di fields and na betta food full di valley. Evritin dey sing and shaut for joy!


But make Yu give joy and happiness to pipol wey dey help mi. Make dem always dey sey, “God dey great and E wont make en savant dey save!”


Pipol wey dey fear God go happy wen dem si wiked pipol dey fall. Dem go use wiked pipol blood take wosh dia legs.


wen doz wey dey stay heaven dey shaut for joy and for morning, di stars dey sing togeda?


My God, make all yor enemies die like Sisera! But make doz wey love Yu, shine like sun!” So peace kon dey for di land for forty years.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka