Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 49:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Just as sheep dey waka like mumu, na so too dem go dey waka until dem enter dia grave; di place where Deat go bi dia shepad and oga. For morning, pipol wey dey fear God go rule ova dem. Dia body go rotin for grave wey nor even dey near dia fine house.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 49:14
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den for di day wen I go do all dis tins, una go mash wiked pipol for groun and dem go bi like ashes under una leg.” Dis na wetin Oga God tok.


Una nor know sey na God pipol go judge di world? And if na una go judge di world, una nor fit setol small-small matter among unasef?


until God wey dey live forever kon judge and favor all en holy shidren. Den di time kom rish for God to take-ova di kingdom.


I know sey Yu dey karry mi go where I go for die; di place wey Yu keep for evribody.


As dem rite am, “Bikos of una, wi dey face deat from morning go rish nite and wi bi like sheep wey dem won go kill.”


For my kingdom, una go sidan chop and drink for my tabol and una go sidan for difren thrones dey judge di twelf tribes for Israel.


And di pipol wey dey serve di Most High God go get royal pawa wey go dey forever and ever.’


Wen Yu ponish us for awa sins, Yu dey remove awa pawa like rat wey dey chop pesin food. But each of us, na just breeze wey dey blow pass.


Bikos en vexnashon nor dey tey, but en favor dey last forever! Even doh I kry for nite, I know sey joy go kom for morning.


So make wi serve God. As far day dey break and rain dey fall for di eart, E go kom save us.


But my God, Yu know mi! Yu dey si evritin wey I dey do and how I love Yu rish. Make Yu take dis wiked pipol komot like sheep wey dem won go kill. Tell us wen dem go die.


By den, yor body go-go back to groun where e from kom, while di spirit go-go back go meet God wey bin gi-am to yu.


E distroy di pipol wey dey before us kon put awa enemies under awa leg.


Yu don busher us give dem like animal wey dem won chop kon skata us among di nashons.


Wiked pipol go die enter grave. Dis na wetin go happen to all di pipol wey rijet God.


But evribody must die. Dem dey beri who don die and worm dey kover di body.


Dem dey live dia life for peace and dey die without trobol.


Dem go take evritin wey e get and e die without wisdom.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka