bikos my enemies nor dey tok di trut. Wetin dey hongry dem to do, na to distroy odas; dia troat bi like open grave and na so-so lie-lie words full dia mout.
Wen Absalom dey alive, e build one big house for di King Valley for ensef. Since e nor born boy pikin wey go ansa en name, e kon give di house en own name and till today, dem dey koll di house, “Absalom Monument.”
Den Samuel stand up wen day neva break well-well kon go meet Saul. But dem tell Samuel sey, “Saul don go Karmel where e dey build image for ensef. Den Samuel go Gilgal.”
Manasseh pikin, Jair take Argob aria go rish Geshur and Maakat pipol borda (wey bi Bashan), den e shange di town name to en name. And na Havvot-Jair dem dey koll am till today.)
Wise pipol dey si where dem dey go, but foolish pipol dey waka fall for darkness. But I still si sey, both wise and foolish pipol dey sofa di same tins.
Some pipol work with wisdom; with wetin dem know and with dia skill; but dem go still die leave evritin for anoda pesin wey nor work at-all. Dis tins dey yuzles and nor dey good at-all.