Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 48:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Bikos na so God bi! Na-im bi awa God and E go guide us forever and ever.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 48:14
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den I go always guide and satisfy una with good tins. I go make una dey strong and well. Una go bi like gardin wey get plenty wota and like wota wey nor go ever dry.


Yu dey guide and advise mi as Yu dey lead mi enter where glory dey.


But wen God Spirit kom, e go show una di trut. E nor go tok wetin dey en mind, but e go tok wetin e hear from God and wetin go happen afta I don go.


Doz wey dey honbol, E dey help dem do wetin dey rite, bikos E dey tish dem en ways.


My body fit fail and my spirit fit weak, but na God dey make my heart strong; na-im bi my own forever.


But my Oga God, I trust Yu, bikos na Yu bi my God!


I tell my Oga God, “Na Yu bi my Masta! Evry good and betta tin wey I get, na Yu give dem to mi.”


I dey follow korrect judgement and I always dey do wetin dey rite,


Anytime I remember all dis tins, I know sey I still get hope.


Weda na for two days, one mont, one year or if e tey pass so, as long as di kloud still kover di Tabanako, dem nor go komot go anywhere; but wen di kloud nor dey, dem go kontinue dia journey.


Yu don make Israel pipol yor own forever and Yu, my Oga, don bi dia God.


Naw wey I don old well-well, make Yu nor leave mi. Make I tell dis new generashon and all doz wey dey porshu mi about yor pawa.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka