Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 48:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Make Zion pipol rijoice. Make all di towns for Judah happy, bikos of di way God dey judge.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 48:11
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Jerusalem pipol and all di towns for Judah don hear about am and dem dey happy, bikos of how God dey judge pipol!


Evribody wey dey heaven, God pipol, di apostles and profets, make una happy bikos God don judge and kondemn am bikos of una!”


Na who nor go fear and praiz yor name? Bikos na only yu dey holy. Pipol for evriwhere go kom woship yu, bikos dem dey si di good tins wey yu dey do.”


But Jesus turn look dem sey, “Jerusalem wimen, make una nor kry bikos of mi, but make una kry for unasef and for una shidren.


Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.


“God sey, ‘Jerusalem town dey laf and play with King Sennakerib.


En mout sweet well-well to kiss and evritin about am, dey sweet mi for body. So, Jerusalem wimen! Dis na wetin my love bi like.


So Jerusalem wimen, make una promise mi with gazelle and deer sey una nor go disturb awa love.


Jerusalem wimen! Make una promise mi with animals, like deer and gazelle sey, una nor go disturb awa love.


Jerusalem wimen, I bi black and fine woman; I black like Kedar and Solomon tents.


Pipol wey dey fear God go happy wen dem si wiked pipol dey fall. Dem go use wiked pipol blood take wosh dia legs.


My God, make all yor enemies die like Sisera! But make doz wey love Yu, shine like sun!” So peace kon dey for di land for forty years.


God sey, “From east go rish west, pipol go honor my name for evriwhere. Dem go burn betta incense and offa betta sakrifice give mi, bikos my name go dey great among all di nashons.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka