Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 48:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 My God, as yor name bi, na so dem go praiz Yu for evriwhere for di eart. Na viktory full yor strong rite hand.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 48:10
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God sey, “From east go rish west, pipol go honor my name for evriwhere. Dem go burn betta incense and offa betta sakrifice give mi, bikos my name go dey great among all di nashons.


Pipol go praiz God name from east go rish west.


“If una nor gri obey my law, di tins wey dem rite for dis book or una nor gri fear di Oga una God wonderful name,


Wen Kanaan pipol and evribody wey dey stay di land go hear wetin happen so, all of dem go kom distroy us and nobody go remember us. My Oga God, wetin Yu go do to keep yor respet?”


So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.


Den I si heaven open and one white horse dey kom out! Dem dey koll di Pesin wey dey ride di horse, “Faithfulnes and Trut.” E dey judge without parsha or wayo even as E dey go fight war.


bikos en judgement dey true and korrect. E don ponish dat ashawo wey spoil di world with en sins, as e dey sleep with who e nor marry and God don revensh am for Christ savants wey e kill!”


Curse dey di pesin head wey dey play wayo and offa yuzles animal, wen e bi sey e get many betta animals wey e promise sey e go give mi! I bi strong king and all di nashon dey fear mi.”


God dey rite for evritin wey E dey do; na goodness full en body.


Di king dey strong; E love to judge well. God dey make sure sey dem judge evry kase well. Na Yu make betta judgement and raitiousness dey for Israel land.


Yu love wetin dey rite kon hate wiked tins. So Oga wey bi yor God don anoint yu as E pour en oil for yor head kon make yu high pass any oda pesin.


God dey good and E dey judge well; so E go favor doz wey dey do good too.


Na-im bi di Oga awa God! Na-im dey judge di whole eart.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka