Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 44:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Na yor pawa wi go take porshu awa enemies; na yor name wi dey take mash dem for groun.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 44:5
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

and wi know sey, with God help, wi go do mighty-mighty tins, bikos E go distroy all awa enemies.


But with awa God help, wi go get viktory, bikos E go help us mash awa enemies for groun kon win dem.


I fit do evritin thru Christ wey dey give mi pawa.


Josef get bull strent and wiked melu horn. E go rule pipol kon porshu dem rish di end for di eart. Dis na my blessing for Efraim and Manasseh pipol.”


Judah pipol go win and mash dia enemies for portor-portor. Wen dem go fight, dem go win dia enemies, bikos mi God dey with dem.


I si di ram dey waka with en horn dey go west, nort and sout-side. No animal fit stop am or eskape from en pawa. E dey do wetin e like and dey bihave anyhow.


Una go mash lions and kobra pass; una go mash wiked lions and snakes go dey under una leg!


And God wey dey give peace, go soon distroy Satan for una. Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una.


One among dem wey en name na Kenaana wey Zedekaya born kon use iron make horn, den e tell King Ahab, “Dis na wetin God tok, ‘Na dis tin yu go take fight Siria pipol kon win dem finish.’ ”


Make Yu listin to my vois for morning, bikos evry morning, I dey kom meet Yu and dey wait with patient make Yu ansa mi.


Bikos God wey bi awa ruler, kommander and king, go diliver us.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka