Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 44:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Na Yu bi my King and God. Na Yu make Israel pipol win.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 44:4
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But Yu God don bi my King since my grand-grand papa dem time and Yu dey save us for dis world.


But evriday, God dey pour en love wey nor dey fail for my life and evry nite, I dey sing en song, dey pray to God wey give mi life.


Wen Jesus si sey pipol dey gada, e kon tell di evil spirit, “Yu deaf and dumb spirit, I kommand make yu kom out from di boy and nor enter en body again.”


Yes! Awa proteshon dey kom from God and na en wey bi di Holy One for Israel, bi awa king.


Jesus sorry for di man, so e tosh am kon sey, “I wont, so make yu well!”


Jesus go meet am, hold en hand and di woman kon stand up. Den di fever komot from en body and e kon dey serve dem.


Israel pipol, make una happy bikos of di Pesin wey kreate una. Jerusalem pipol, make una praiz God well-well.


Bikos God wey bi awa ruler, kommander and king, go diliver us.


My Oga God, yor rite hand get betta pawa and e skata di enemies to pieces.


But na bikos God love una and dey keep di promise wey E make with una grand-grand papa. Na dis make God save una with en strong hand wen una dey serve as slave for King Fero hand for Egypt.


di betta judgement wey una si, di signs and wonders wey God do; en strent and pawa wey E use take-take us komot der and na so di Oga una God go do to all dis pipol wey una dey fear.


I send fear go for una front go drive di two king for Amor. I give una viktory, even wen una nor use swod, bow or arrow.


E don show en pipol en great pawa wen E give dem oda nashons land.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka