Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 44:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Yu use yor pawa take porshu doz wey nor dey fear Yu kon give all di land to awa grand-grand papa dem. Yu skata dia enemies kon free awa grand-grand papa.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 44:2
27 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Yu go take dem enter inside di land kon plant dem for yor mountin; di place where Yu choose as yor house, bikos na Yu wey bi my Oga God, build am as yor own Temple.


E porshu di nashons wey dey before dem kon divide dia propaty give en pipol. E make Israel pipol relax for dia house.


I don choose place for my pipol Israel and I don put dem for where dem go stay and nobody go opress dem again.


So God give Israel pipol all di land wey E promise dia grand-grand papa and dem win am kon dey stay der.


Joshua win di whole land, just as God promise Moses. Den Joshua give di difren tribe for Israel di land, as dia own. Den di land kon get peace and di war kon stop.


Doz wey nor know am, E give dia land to Israel en pipol and dem plok fruit wey odas plant.


I send fear go for una front go drive di two king for Amor. I give una viktory, even wen una nor use swod, bow or arrow.


Joshua katch all dis kings and dia land for just one fight, bikos di Oga wey bi Israel God dey fight for en pipol.


As dem dey run from Israel pipol go di low groun for Bet-Horon, God kon make big-big stone dey fall from sky for dia head go rish Azeka. Dem die well-well and di ones wey di stone kill, many pass doz wey Israel sojas kill.


Joshua sey, “Na like dis una go take know sey, God wey nor dey die dey with una and E go really porshu Kanaan, Hit, Hiv, Periz, Girgash, Amor and Jebus pipol komot for una.


Wen di Oga una God take una enter di land wey una go-go stay, E go porshu many kountries komot for una. Kontries like: Hit, Girgash, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol. (Di pipol for dis seven kountries get pawa pass una.)


So dem make Israel pipol bilive sey dem nor go fit konker di land wey dem go spy kon dey sey, “Di land nor go fit produce food for all di pipol wey dey stay der. All di pipol wey wi si der, big well-well


Make yu obey wetin I dey kommand yu today. I go drive Amor, Kanaan, Hit, Periz, Hiv and Jebus pipol komot for una.


I go send fear like ant go drive Hiv, Kanaan and Hit pipol komot before una go rish der.


“Wen Fero men with dia shariot enter di sea, Oga God kon make wota swallow dem, but Israel pipol waka pass for dry groun.”


All dis tins dey happen, so dat yu go fit tell yor shidren and grand-shidren how I take fool Egypt pipol with my mirakles, make dem for know sey na mi bi God.”


E porshu kountries wey strong pass una komot from dia land, so dat una go fit take di land kon stay der forever.


Make una remember as e bi before, make una tink about di generashon wey don pass. Make una ask una papa and una eldas and dem go tell una evritin.


Gideon ansa, “My Oga! If God really dey with us, wetin make all dis tins dey happen to us? And where all di mirakle wey awa grand-grand papa dem tell us? Bikos dem sey, ‘Na God take us komot from Egypt!’ But naw, God don forget us kon allow Midian pipol dey rule us.”


but Shammah nor run and e fight and kill all of dem. God give dem viktory dat day.


Oga God, make Yu raiz-up kon help us! Save us with yor pawa. Make Yu use yor pawa, just as Yu dey do before. Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea, na Yu kut am to pieces.


But wen dem kom dis land kon dey stay as dia own, dem nor kon dey obey yor kommand or do wetin Yu tish dem; dem nor do wetin Yu orda dem to do and na dis make Yu distroy dem.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka