Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 44:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Yu make us run from awa enemies kon allow pipol wey hate us, pak awa propaty.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 44:10
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

“Why wi nor just stay for di oda side for Jordan River! Wetin I go tok naw wey Israel pipol dey run from dia enemies?


I go turn against una kon make una enemies win and di pipol wey hate una, go rule una. Fear go katch una sotey una go dey run wen nobody dey porshu una.


Anybody wey dey pass, dey tif from am and en neighbours don take am dey do yeye.


Israel pipol nor fit stand for dia enemies front; dem run bikos disgrace don dey follow dem. I nor go dey with una again, unless una distroy wetin make dis wahala dey happen to una.


God go still allow una enemies beat una; una go attack dem from one side, but una go run komot seven side, den all pipol for di eart go dey fear bikos of wetin hapun to una.


Na only bad-bad tins and deat I dey profesy about. Na only curse and trobol yor message don bring kom meet mi.


I go send enemies kom tif una propaty and dis go bi ponishment for di sins wey una kommit for di land.


All di nashons bi like bird house for my hand and I gada dia propaty just as dem dey gada egg. Yes! No feada fit make mi fear and no bird fit open en mout sey e won bite mi!”


I send Assyria pipol go attack di nashons wey nor know mi kon karry, tif and skata di pipol like dirty for street.


Di man ansa, “Israel pipol don run from Filistia pipol! Dem don kill di sojas well-well! Yor two boys, Hofni and Finehas, don die too. And dem don karry God Kovenant Box go!”


God kon tell dem, “If una nor obey my kommand, I go ponish una.


Make una nor go, bikos God nor dey with una and una enemies go win una,


bikos Amalek and Kanaan pipol dey wait una and dem go kill una well-well. Bikos una don turn from God, E nor go-go with una.”


For dat time, I go vex for dem well-well kon leave and hide my face from dem until dia enemies kill dem finish. Many wahala and trobol go ovakom dem and dem go sey, ‘Dis wahala don finish us, bikos God no dey with us again.’


But with awa God help, wi go get viktory, bikos E go help us mash awa enemies for groun kon win dem.


Yu don forget di kovenant wey Yu make with am kon trow en crown for dust.


Yu make sure sey en swod nor mean anytin and Yu nor gri help am for war again.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka