4 Make una si as pipol wey trust God dey happy; doz wey nor like proud pipol or woship juju.
Make yu kom try God, den yu go si sey God dey good: Make yu si as God bless di pipol wey bilive am!
but make Yu ponish pipol wey dey do bad tins. Ponish dem with all di oda wiked pipol. Make peace always dey Israel land!
Make una dey respet God well-well or E go fit vex kon distroy una at wons, bikos of di way una dey bihave. But na blessing dey follow doz wey si am as dia Oga God!
Doz wey dey woship juju, don abandon di good tins wey God suppose do for dem.
Doz wey hate pipol wey dey sin and honor doz wey dey fear and follow God! Pipol wey dey do wetin dem promise even wen e dey pain dem.
Yu porshu sturbon pipol; doz wey nor dey obey yor kommand and bikos of dis, curse dey dia head.
Make una sing new song take praiz am; make una play di harp make e loud well-well.
Yes! Yu don dey with mi since wen dem born mi and Yu dey kare for mi from my mama belle. No wonder I dey always praiz Yu!