Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 40:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 E take mi komot from di pit where shame, pain and sofa full kon put my leg for groun wey strong well-well, den E make mi strong as I dey waka.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 40:2
24 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God dey lead doz wey dey fear am. E dey-dey happy with evritin wey koncern dia life.


Make yor words guide my step, so dat I nor go waka enter evil.


Bikos E go must guide mi wen trobol kom kon hide mi for en temple. E go put mi on-top one high rock where nobody go fit tosh mi.


From di end of di eart, I kry kom meet Yu for help, bikos trobol don make my heart heavy. Karry mi go di high mountin, where I go for dey save.


Even doh Yu don make mi sofa well-well, I know sey Yu go make mi happy again kon take mi komot from di pit wey I dey.


bikos di love wey Yu get for mi, big well-well and Yu don save mi from deat.


I dey sink enter mud; di place wey di groun soft well-well. I dey for deep wota and di wota dey karry mi go.


God sey, “Bikos of di sakrifice and blood kovenant wey I make with una, I go free una pipol from slave work.


Yu don make betta road for mi, so dat I nor go draw fall.


But God kon raiz am up afta E don gi-am pawa to win deat, bikos deat nor get pawa to hold am.


My enemies don porshu mi. Dem don nak mi fall kon force mi stay for darkness like pipol wey dey grave.


Na only yor ways I dey follow; I neva stop to follow Yu.


bikos deat kover mi like klot and di fear to die go grave, dey make mi shake. Na only sorrow and trobol I dey si.


and dem go trow evil pipol inside hell-fire, where dem go kry and grind dia tit.”


God go gada dem put for pit, lock dem for prison and afta dem don stay der tey, E go kon ponish dem.


Fear kon make di pipol for di eart dey shake. Di mountins foundashon kon dey shake too; dem dey shake bikos God dey vex.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka