Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 40:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Trobol gada round mi and I nor fit kount dem! My sins don many well-well and I nor sure sey I go fit dey free from dem! Dem many pass di hair wey dey my head and I don lost all my hope.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 40:12
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I dey die inside my own sin and dis wahala too heavy for mi to karry.


My body fit fail and my spirit fit weak, but na God dey make my heart strong; na-im bi my own forever.


Pipol wey just hate mi wen e bi sey I nor do dem anytin, many pass di hair wey dey my head. Doz my enemies wey won distroy mi without any rizin, too plenty to kount. Dem dey make mi pay for wetin I nor tif!


bikos deat kover mi like klot and di fear to die go grave, dey make mi shake. Na only sorrow and trobol I dey si.


So God, how I won take know all my fault? Make Yu klean mi from di bad tins wey I do wey I nor know.


All of us bi like sheep wey don lost and wi dey waka go awa own way. But God gi-am di ponishment wey suppose bi awa own.


Bikos of sin, Christ sofa. En wey nor do bad, sofa for doz wey do bad, so dat e go karry us go meet God. And wen dem kill-am, e wake-up as spirit.


Dis awa High Priest undastand us wen wi dey weak, bikos all dis temptashon wey wi dey face so, e face dem too, but e nor sin.


Pipol go dey faint and fear go dey katch some, bikos of wetin dey happen for di world and difren pawas inside di sky, go shake komot for where dem dey.


Den e tell en brodas, “Dem return my money give mi! E dey for inside my sak!” Dem sopraiz well-well kon turn face each oda with fear, den dem sey, “Na wetin God don do to us so?”


Den, I go dey sing praiz yor name forever kon dey do wetin I promise Yu.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka