Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 4:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Yu don give mi more joy pass doz wey get many food and wine to drink.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 4:7
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Yu don make di pipol plenty kon give dem great joy. Dem dey happy for yor present, just as doz wey dey harvest wetin dem plant dey happy or as sojas dey celebrate wen dem divide wetin dem karry kom from war.


Make yu depend on God and E go give yu evritin wey yu wont.


For der, I go-go God altar; di God wey dey give mi joy kon praiz am with my harp!


but E nor stop to do good for una, E dey give una rain from heaven and food from groun, so dat una go chop and belle go sweet una.”


Draw mi follow yu! Make wi kwik komot here! Make di king take mi go en room. Awa king, wi dey happy well-well, bikos of yu and wi like yor love pass wine. Yes, di yong wimen dey honor yu and dat na di rite tin to do.


My God, Yu dey make mi happy bikos of evritin wey Yu do and I go sing praiz Yu, bikos Yu dey good to mi.


Di happiness and joy wey dey Moab land, don vanish. I don make dia wine stop to flow from di winepress. Nobody dey to make wine for dem and una nor go hear happiness nois from der again.


All of dem go dia vineyard go pick grape kon make wine take do party. Dem go dia god temple dey drink, chop and curse Abimelek.


Aldo una neva si am, but una love am. Una nor dey si am naw, but una bilive am, una get happiness and glory wey una nor go fit esplain.


God go dey kind and good to una;


My God, nor let dem disgrace mi, bikos I dey koll make Yu kom help mi. Instead, make disgrace follow wiked pipol and make dem die go dia grave, where dem go dey silent forever.


Den pipol wey dey for di world go know wetin Yu like; all di nashons go know how Yu take diliver yor pipol.


My Oga wey bi God for Heaven Sojas, na how long Yu go dey vex for awa prayers?


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka