Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 4:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 My God, make Yu ansa mi wen I koll Yu. Na only Yu go fit diliver and free mi from wiked pipol and all my trobol. Make Yu sorry for mi kon hear my prayers.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 4:1
35 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

E save us from deat and E go diliver us. Wi don put awa hope for en hand sey E go diliver us again.


Make Yu kom show mi yor mesi, just as Yu dey do to evribody wey love yor name.


Make Yu turn kon sorry for mi, bikos na only mi dey and I dey sofa well-well.


Wen e bikom king, Judah pipol go dey save and Israel pipol go stay for peace. Dem go koll am, ‘Na God bi awa raitiousness.’ ”


My God, I dey pray to Yu, bikos I know sey Yu go ansa. Abeg, make Yu listin to mi as I dey pray.


God wey get pawa dey give mi strent. E make mi stand strong for groun like deer kon keep mi save on-top di mountin. (For di kwayamasta: Make dem sing dis song with instrument like, jita.)


Dem go sey, ‘Yes! Na only God get pawa to save pipol and anybody wey hate am, na disgrace go follow dem.’


Make Yu nor judge mi yor savant, bikos evribody dey guilty for yor front.


My God, make Yu sorry for mi. Abeg, sorry for mi, bikos na Yu dey protet mi. I go hide under yor shadow until I don free from all dis wahala.


Na betta words full my heart for di king and I go use my vois praiz am, just as dem dey use biro rite for book.


My God, my God, wetin make Yu forget mi? Wetin make Yu dey far from mi wen I dey kry for help?


David still sey, “God wey diliver mi from di lion and di bear, go still diliver mi from dis Filistia man hand!” Den Saul kon tell David, “Make yu go fight am and make God dey with yu.”


My brodas and sistas, wi wont make una know about di wahala wey wi face for Asia aria. Di trobol wey wi face, heavy well-well and life kon taya us.


Una don bi Christ friends bikos of God and na thru Christ wi get wisdom, goodness and holiness wey kom from God;


God don show ensef to Judah pipol. En name dey great among Israel pipol.


Make God show us en favor and bless us! Make E always dey happy with us!


My God, just as deer dey find wota to drink, na so too I dey find Yu.


Yu nor give mi to my enemies and Yu don put mi for where I go dey save.


Dem go get God blessing kon bi di God wey dey save dem, friend.


God dey good and E dey judge well; so E go favor doz wey dey do good too.


My God, I bi yor savant; yes, I bi yor savant wey dem born for yor house and Yu don free mi from di shains kon save mi from deat.


God dey protet pipol wey dia faith neva too strong and even wen I dey face deat, E kom save mi!


My God, make Yu sorry for mi, bikos pipol dey attack mi. My enemies dey attack mi evriday.


Instead, Yu don keep my life, bikos I dey innocent; Yu don let mi enter yor present forever.


My God, make Yu nor drive mi, bikos Yu dey vex. Nor ponish mi with yor vexnashon.


God remove yu from trobol kon make yu dey save and yu get food full yor tabol.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka