Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 39:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 My God, make Yu hear my prayers! Make Yu listin to my kry for help! Make Yu dey look di tears from my eye. I bi like pesin wey travel kom stay with Yu, just as my grand-grand papa dem bi to Yu.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 39:12
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

My friends, I dey beg una, since una bi strenjas for dis world, make una nor follow di tins wey pipol like to do, bikos dem dey distroy pesin soul.


All of dem faith still strong wen dem die and dem nor get di tins wey God promise dem, but dem si and welkom di tins from far and dem gri sey, dem diasef na strenja for dis world.


Na strenja I bi for dis world, so make Yu nor hide yor kommand from mi!


“ ‘Una nor go sell una land forever, bikos di land na God own and una bi strenja wey God allow to use di land.


Jakob ansa Fero, “I don stay for more dan one hundred and thirty years. And all di years wey I don spend for dis life nor many, but e nor dey eazy; di years wey I don stay, nor many rish di years wey my grand-grand papa dem stay.”


Since una dey koll God wey dey judge evribody akordin to wetin e do, “Papa”, make una live una life with respet for am.


Yu know di pains wey I dey face. As I dey kry, Yu put all my tear for bottol kon rite wetin I dey sofa for yor book.


Awa Oga God! Yu know sey wi dey pass thru dis world like strenjas, just as awa grand-grand papa dem do. Awa days bi like shadow wey dey fade and wi nor fit run from deat.


“Make yu go back go meet Hezekaya, wey dey rule my pipol kon tell am sey, ‘Mi God wey bi yor grand-grand papa David God don hear yor prayer and si as yu dey kry. I go heal yu and afta three days yu go-go back to di temple.


Wen Jesus still dey dis eart, e pray and kry to God wey go save am from deat. God hear en prayers, bikos e obey God for evritin.


bikos deat kover mi like klot and di fear to die go grave, dey make mi shake. Na only sorrow and trobol I dey si.


My friends dey tok against mi and I dey kry give God.


May bi God go si my sorrow and E go give mi some blessing wey go remove dis curse.”


So, wi dey always get mind and wi know sey, as long as wi dey alive for dis eart, wi nor dey where God dey,


My God, make Yu hear my prayer! Make Yu listin to my kry for help!


Anywhere wey I dey, na yor law bi di song wey I dey sing.


Abraham stay for Filistia pipol land tey small.


Naw, I don turn rotin wood and I bi like klot wey worm chop anyhow.


Yes! As wi dey alive, wi dey si as Yu dey vex and awa years dey kwik-kwik end.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka