9 So, Oga God, I know sey Yu know wetin I wont. Yu dey hear as I dey kry with pain.
Oga God, na Yu bi di hope wey poor pipol get. True-true, Yu go hear dia kry kon konfort dem.
I don taya to komplain, bikos evry nite, I dey wet my bed with wota from my eyes.
Bikos for dis awa house for eart, wi dey struggol, bikos wi nor fit wait to wear awa new body for heaven.
Netanel ask am, “How yu take know mi.” Jesus ansa, “Before Filip koll yu wen yu dey under di tree, I don si yu.”
Bikos of di pains wey I dey feel, my bones don almost kom out from my skin.
to hear di prisonas kry for help and to release doz wey dem won kill.