8 Make yu nor dey vex, bikos na trobol, vexnashon dey bring.
Pipol wey get sense, dey kontrol demsef wen dem dey vex; but doz wey dey kwik vex, dey show as dem foolish rish.
E betta to dey patient dan to bi strong warrior. E betta make yu kontrol yorsef dan to kontrol di whole town.
Una must stop to get bad belle; to dey vex; kworel and to dey tok bad-bad word.
If una dey vex, make una nor sin and make day nor dark still meet una dey vex.
but naw, to dey vex anyhow; to get bad mind for pesin; to take mout spoil pesin and to dey curse pipol, make una remove dem from una life.
Na vexnashon dey kill who nor get sense and na jealousy dey kill fool.
Jonah nor happy bikos of wetin happen, so e kon dey vex.
But God tell am, “Wish rite yu get to dey vex bikos of di small plant?” Jonah ansa, “I get evry rite to vex till I die!”
Yu just dey kill yorsef with vexnashon. Make di eart skata, bikos yu dey vex? Abi make mountins shake komot where e dey?
If to sey I don tok dis tins wey I dey tink, I for don betray doz wey dey obey Yu.
I kry to Yu as I dey fear kon sey, “Dem don take mi from Yu!” But Yu hear my kry for mesi kon ansa my prayer for help.
As I dey vex, I kon sey, “Evribody dey lie well-well!”
Di king ask am, “Why yu won go? E get anytin wey yu wont, wey I nor give yu? Wetin make yu won go yor kountry back?” Hadad ansa, “Abeg, my king, make I just go,” So e kon go back to en kountry.