10 Wiked pipol go soon vanish and wen una look for dem, una nor go si dem again.
Wiked pipol fit dey great naw, but e nor go tey before dem go die go like grass and korn wey dem kut trowey.
Di time wen evritin go end don near. So make una dey kontrol unasef and shine una eye wen una dey pray.
Wons heavy breeze blow, di flower dey die komot like sey e nor dey der before.
But God go distroy yu wons and for all. E go remove yu from yor house kon distroy yu from dis world.
E nor go ever kom back to en house and nobody go si am again.
Wi know sey even wise pipol must die; both fools and doz wey dey spiritual still dey die too and na odas go kollect evritin plus di money wey dem get.
But if pesin die, na di end bi dat. Dem don die; so where dem dey naw?
So dem kon hang Haman for di pit wey e dig for Mordekai. Den di king kon stop to vex.
Yu nor fit just forgive mi my sins? Yu nor fit just sorry for all di bad tins wey I do? I go soon die and wen Yu dey look for mi, I go don go.”
Jehu kon orda Bidkar, en offisa sey, “Make yu go karry en dead body trow for di land wey bi Nabot for Jezrel own before. Remember sey mi and yu dey ride with Ahab en papa wen God tok about dis tins sey,
wikedness nor dey and di joy wen pesin wey nor dey fear God get, nor dey last.
Dem go distroy wiked pipol house, but doz wey dey fear God, go prosper.