6 I pray to God as I dey sofa and E ansa mi; E save mi from evritin wey dey worry mi.
Wen I kry to God for help, E ansa mi from en holy hill.
Oga God, na Yu bi di hope wey poor pipol get. True-true, Yu go hear dia kry kon konfort dem.
David sing dis song afta God save am from Saul and en enemies:
I dey poor and I nor get anytin, so make God keep mi for en mind. My God, make Yu kwik kom, bikos na Yu bi my help and di Pesin wey go save mi.
di Angel wey don protet mi from all wahala, bless dis boys. My name and my papa Abraham and Isaak name go shine for dia life. Dia shidren go many like san-san for dis eart.”
So, Hannah kon sey, “Make mi, yor savant get favor for yor eyes.” So di woman go find wetin e go chop and e kon dey happy.
Yu hear my kry for help wen I sey: ‘God make Yu listin to mi well-well!’